Plenty congratulations don dey enta for Nigeria media personality Toke Makinwa, afta she announce say she dey expect her first child.
Di 40-year-old popular radio and television host wey post video of her baby bump on top her Instagram account on Wednesday, 13 August say dis na, “di biggest project of my life, di highest calling ever!”
Popular Nigerian celebrities and plenty ogbonge Nigerians wey include Funke Akindele, Kemi Adetiba, Iyabo Ojo, Falzthebadguy, and plenty odas dey among those wey first congratulate her.
Di popular social media personality wey reflect on how di journey take start to be a mother say dis na her prophetic declaration as she enta year 2025. She add say di pregnancy na testimony of God perfect timing.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post