Wia dis foto come from, Reuters
Ukraine President Volodymyr Zelensky dey currently meet wit US President Donald Trump for White House.
Some European leaders also dey for di White House wia di meeting dey happun.
Na three days ago, Trump bin personally greet di Russian leader Putin as e step off im plane to red carpet, while fighter jets dey move ova im head.
Zelensky arrival for Washington dey lowkey but e no mind as di Ukrainian president dey more concerned about how di war for Ukraine go end.
Wia dis foto come from, Muhammed Selim Korkutata/Anadolu via Getty Images
How di meeting dey go?
Dis meeting wit Trump fit likely be one of di most important for Zelensky political career.
Wen one reporter ask Trump if consequence go dey if ceasefire no dey, Trump say: “I no tink you need a ceasefire.”
Di US president say “e fit dey good to get” but e add say e fit no dey necessary for peace.
E also tok say “strategically”, one kontri or di oda fit no want ceasefire.
Bifor di meting, di President Trump bin say Zelensky fit end di war between Russia and Ukraine “if im want to” but im give some conditions.
Meanwhile, di conditions na say Ukraine no go join Nato as part of a peace deal and Ukraine no go fit collect Crimea peninsula back from Russia.
Di President of di European Commission, Ursula von der Leyen, also dey for White House. She bin step out of her car wia di chief of protocol Monica Crowley greet her and say e dey “good to see you again”.
British Prime Minister Sir Keir Starmer bin also arrive wit smiles as e comot im vehicle and enta di White House.
President of Finland Alexander Stubb also pull up to di White House.
Nato chief Mark Rutte also dey White House – na im be di first of di European leaders wey arrive.
Meanwhile, Italy prime minister Giorgia Meloni, also dey for Washington today for di White House summit.
Italy prime minister tok for native Italian language say she dey happy say di proposal for Nato-like security guarantee dey part of today tok.
“We dey on di side of Ukraine, we support di efforts of di president of di United States,” she tell reporters.
Who Trump and Zelensky bring along to di White House meeting?
Di White House bin confam say five US officials go dey present for di room wit Donald Trump wen Volodymyr Zelensky meet di US president for di Oval Office today.
Dem be Vice President JD Vance, Secretary of State Marco Rubio, White House Chief of Staff Susie Wiles, special envoy Steve Witkoff, and special envoy Keith Kellogg.
Zelensky go also dey accompanied by Andriy Yermak, im top chief of staff and Rustem Umerov, former defence minister and now head of di National Security and Defence Council of Ukraine.