Wia dis foto come from, Franck Fife/AFP via Getty Images)
First Half
32′ Victor Osimhen don comot sake of injury Cyriel Dessers don replace am.
30′ E be like say Victor Osimhen get in jury , e dey unstable since dem tackle am and im dey get medical attention now.
29′ Nigeria don get three beta chances to score Rwanda but Rwanda defenders no dey let di Super Eagles balance to play di ball.
27′ Throw-in for Nigeria, Ola Aina throw am but e land for Rwandan player head wey clear di ball fro counter attack attempt.
25′ YELLOW CARD Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali afta e bin wan go fight sake of small kwanta wey happun between Nigeria and Rwanda players for field. Na di first yellow card of di game be dis.
23′ Rwand win freekick afta two Nigerian players tackle am. Dem play di freekick but e lead to goal kick.
20′ Ademola Lookman of Nigeria head di ball for di goal area but e go wide.
17′ Freekick for Rwanda, dem play am into di hands of Nigeria goalkeeper.
13′ Rwanda collect ball from di resulting goalkick as dem try counter attack on Nigeria but notin come out.
12′ Victor Osimhen of Nigeria dey beta position to score but Rwanda defender tackle am fall, e manage pass di ball team member wey fire di ball wide.
10′ Nigeria make anoda goal attempt to score Rwanada but goalkeeper save am.
7′ OFFSIDE! Ademola Lookman bin score but Linesman say na offside.
6′ Ademola Lookman of Nigeria try to score nut dei ball go side of di goal post as Rwandan goalkeeper catch di ball.
5′ Nigeria still dey hold ball di ball pass di Rwandans as dem dey try force di Rwandans out from dia goal post.
4′ Victor Osimhen of Nigeria make attempt on goal but notin come out.
3′ Nigeria dey try to hold possession of di ball.
1′ Referee blow whistle match don start
Di Super Eagles of Nigeria dey face Rwanda for di qualifiers game to fight for place for di 2026 Fifa World Cup.
For Nigeria, dis na veri important match for dem sake of say dem need all three points to stand a chance to qualify.
Howeva, failure to grab good thre points mean say dia hope to qualify for di World Cup don fail.
Well, Rwanda sef no come to play as dem go do to win dia best to beat Nigeria for di Godswill Akpabio International stadium, Uyo today Saturday 6 September 2025.
Nigeria dey fourth position for di Group C table wit seven points while Rwanda dey second position wit eight points.
Both teams dey expect to win so dia chance go fit go up to qualify to give dia fans joy.
Meanwhile, na nine group winners at di end of 10-match campaign go qualify for di 2026 World Cup, while a 10th African team go qualify through di intercontinental play-off.
Na South Africa dey lead Group C currently wit 16 points.
For June 2024, Super Eagles of Nigeria bin fail to beat di Bafana Bafana of South Africa for di 2026 Fifa World Cup Qualifier wey hapun for Uyo.
Dat na di third time unbeaten for South Africa as Nigeria fail to beat dem again for home soil, Uyo, di Akwa Ibom State capital.
Wen be Nigeria vs Rwanda
Super Eagles dey host Rwanda on Saturday (16:00 GMT) for Uyo, Akwa Ibom State, southern Nigeria.
Di match na by 5:00pm Nigerian time, and we go give una live text commentary of how e dey go here for BBC News Pidgin.
Who get chance to qualify for Group C
South Africa get beta point lead and Nigeria dey struggle for fourth place, but Group C get small comma.
World Football governing body Fifa still neva rule on di mata wey dem carry go dia dormot say South Africa field illegal player.
South Africa bin beat Lesotho for March – and if dem award di 3-0 victory wey South Africa get to Lesotho den di group go open well.
Weda dis mata go favour Bafana Bafana or not, Nigeria must get maximum points or dem go miss two editions of di World Cup finals back to back.
Eric Chelle dey lead di Super Eagles to host Rwanda on Saturday for Uyo, Akwa Ibom State, southern Nigeria and dem go travel to Bloemfontein for di ogbonge meeting wit South Africa on Tuesday.
Rwanda and Benin fit still squeeze enta top spot.
Full provisional squad list
Goalkeepers: Stanley Nwabali, Amas Obasogie, Adeleye Adebayo, and Ebenezer Harcourt.
Defenders: William Ekong, Calvin Bassey, Ola Aina, Bright Osayi-Samuel, Bruno Onyemaechi, Igoh Ogbu, Chidozie Awaziem, Felix Agu, and Benjamin Fredericks.
Midfielders: Alex Iwobi, Frank Onyeka, Alhassan Yusuf, Wilfred Ndidi, Fisayo Dele-Bashiru, Raphael Onyedika, and Christantus Uche.
Forwards: Ademola Lookman, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen, Moses Simon, Victor Boniface, Cyriel Dessers, Sadiq Umar, Nathan Tella, Tolu Arokodare, Terem Moffi, and Adams Akor.