Frank Caprio: Champion of kind justice Judge Caprio die at 88

Wia dis foto come from, Getty Images

US celebrity judge and social media star Frank Caprio don die at di age 88, im fmily confam.

Di Rhodes Island judge die afta e dey diagnosed wit pancreatic cancer, im family announce on im official Instagram account. E dey remembered for im “warmth” and “unwavering belief in di goodness of pipo”.

Caprio serve as chief judge of di municipal court of Providence, Rhode Island, from 1985 to 2023.

David Caprio, im son, thank di fans for dia love and support and dem encourage pipo to “spread a little kindness” for im papa memory.

Beloved for im compassion and humour for di courtroom, videos of Judge Caprio as e dey preside ova cases on im hit show Caught in Providence dey get billions of views on social media, wey earn am di title of di “nicest judge for di world”.

For di Instagram statement to im 3.4 million followers, Judge Caprio dey remembered for di “countless acts of kindness e inspire”.

“Im warmth, humour, and kindness don leave ogbonge mark on everybody wey know am,” di statement tok.

Judge Caprio bin preside ova thousands of cases for im hometown of Providence, Rhode Island bifor e start im TV career.

Di company behind Caught in Providence, Debmar-Mercury, don pay tribute to Judge Caprio “unique brand of compassion and common sense approach”.

“We go miss am dearly,” co-presidents Mort Marcus and Ira Bernstein tok for inside statement.

During dia operation, Caught in Providence bin dey nominated for three Daytime Emmys, Judge Caprio get two of im own nominations last year.

Im signature courtroom style don produce viral clips wey include wia e invite children to siddon wit am behind di bench during cases, to announce a “mini-judge” plushie of himself.

One TikTok video wey showcase im morning routine – show as e dey brush im teeth, sign im book and watch videos of im own show – di video get more dan 5m views.

For inside one 2019 interview, Judge Caprio tok say im courtroom proceedings “dey show a slice of life of Rhode Island wey dey very interesting, and e dey show di same issues pipo dey experience nationwide”.

Afta dem diagnose am wit pancreatic cancer for 2023, Judge Caprio say “I dey fully prepared to fight as hard I can” and e thank im followers for dia support.

For one of im last social media posts, Judge Caprio bin announce say im don go back to hospital afta e suffer one “setback” for im treatment and e ask im followers for dia prayers.

Judge Caprio dey survived by im wife, Joyce Caprio, of almost 60 years, dia five children, seven grandchildren and two great-grandchildren.

Continue Reading